Big Big wahala don sama Naija,as e don be say,our federal government dem say,dem no go fit pay workers again for the month of october if militants activities no stop.
I take did opportunity dey advise my people dem wey dey work with government,make dem for shine their korokoro eyes now wey night never come.
O boy,militants na power o,see as dem hang Nigeria for throat sotey wahala come wear coat.wetin wey man go come do for dis Buharia system of government?
As for me,i go say make una my people all come together make for piss for one corner make e foam wella,my talk dey mean say,make all of us put hand and mouth for dis Biafra matter,na only dat matter be the solution to everything wey we dey see today,make we no just do any mistake get another option.
As e dey hot so,me i still stand gidigbam for that matter wey too make brain,that matter wey be say if u neva talk am u neva start and that matter na em be..............
# FreeNnamdiKanu
# FreeBiafra
# SupportBiafra
# BiafraExit
kpom kwem,e don finish as i carry come for today